Na d Chelsea squad wey go play for Champions League knockout stage be dis

Antonio Conte don put all the three of him new January signing for him squad for Knockout Stages of the Champions League.
Na d Players wey go play for Champions League be dis:

Willy Caballero, Thibaut Courtois, Eduardo

Antonio Rudiger, Marcos Alonso, Davide
Zappacosta, Gary Cahill, Andreas Christensen, Cesar Azpilicueta, David Luiz, Emerson Palmieri

Dujon Sterling, Cesc Fabregas, Danny Drinkwater, N’Golo Kante, Ross Barkley, Eden Hazard, Pedro, Tiemoue Bakayoko, Victor Moses, Willian

Kyle Scott*, Alvaro Morata, Olivier Giroud, Callum Hudson-Odoi.

Oga Passion don update us for Alvaro Morata woundjury

Chelsea Oga, Antonio Conte don hala say Alvaro Morata woundjure dey very serious as he dey struggle with back wahala.
Morata no go play against Watford. Conte talk am for him pre-match press conference say “Morata still dey out,we go try solve him wahala but he get problems for him back and he don dey miss many games. No be good thing for him, for me and for the team”
Another player wey go miss the match against watford be Andreas Christensen, the defender catch hamstring woundjure wen Bournemouth flog us 3-0.
Conte talk say “For Christensen, the first test wey we do show say he dey positive, but make we no hurry am, for sure he no go play against watford.”

GINGER FOR CHELSEA, STAR BOY DON TALK AM SAY HIM FIT PLAY

Chelsea new boy Palmieri talk say him no fit wait to play for Chelsea, and come talk am join say him wunjury don comot. Him pass him medical well for Chelsea and e be like say him body don gather well. Him say like baba passion wella and him no sabi say him future under baba passion go shine pass Sun.
Palmieri talk say him don dey sabi everybody for Chelsea already and people don dey turn him padi, and him think am say Chelsea na home for am, na to settle well remain.
“Yes, physically I feel great” na so him talk am give Chelsea website. My six-month wunjury don go, wetin be koko now be say my body don strong”.
Now na to improve under baba passion and to play well for Chelsea be my joy.
As I sabi say baba passion na Italian like me, I go try my best for am make i deliver for Chelsea, and e be say I don already sabi some Chelsea players, e go help me well well for here.

Chelsea Don Sign Emerson

Chelsea don tell every every say dem don sign Emerson Palmieri Dos Santos from Roma. The 23 years old baller sign 4 and half years contract with us. According to wetin dey our website, him go wear number 33 {who remember our defender wey been wear same number?}.

Image credit: Chelseafc.com

Him say premierleague na league wey him don gbadun from when him be small pikin and e sweet am for belle, no be small, say him go play for the league. Marina Granovskaia wey take-over work from bros Emenalo as our director tok say she happy say we fit sign the player, say the player good pieces, and him go dey follow other players drag jersey; say this na good thing for the club.

Emerson neva play for Champions League at all this season so him go fit play any match wey we go like use am for.

Chelsea 4 Pidgin dey hail am from here. Na which name una reason say make we give am?