Gary Neville: ‘The Pesin Wey Reason For Chelsea To Sell Matic Nids Sacking’ 

Former Red Devil Gary Neville don hala Chelsea directors and managers ova Nemanja Matic transfa to Manchester United.

The Serbian midfielder don standa himself for Old Trafford, e don be key-man for José Mourinho side in dis first part of the season.

Matic waka from Stamford Bridge in a £ 35m move last summer but as  Neville take talk dis na big mistake:

“Wetin spoil for Chelsea? One tin. Matic,” Neville talk for BBC Five Live afta the Blues chop akpako 3-0 for Rome yestade.

“E dey as simple as dat. The minute dey sell Nemanja Matic na mistake.

“Wen you get Matic siddon in front of you, with N’Golo Kante by ur side, no shaking.  The pesin wey take dat decision nids sacking. Dat na one of the poorest decisions I don see for Premier League.

“If you ask any of dose Chelsea players who dey go like make e come back, dey go say Matic. Chelsea replace am with someone who go do the same job,Bakayokohama haba,  no be dat player, e no be holding midfield player.

“Dey no replace Matic. I for no let am out of the building, I for chain am to training ground walls.”

Leave a comment